E get one dream
Wey dey worry me
I don dream am tire
Di dream bi say
I wan bi President
I never see president hungry
I never see president thirsty
President no go worry for road
Police no go stop-am for checking
President no go worry for house
Na government cook dey prepare food
Na government dry cleaner dey wash cloth
Na government driver dey drive motor
Na him make I wan bi president,
I wan bi president
Make I get plenty titles
Dem go call me di Excellency
I fit bi Field-Marshal and Admiral
I go bi Lion of di Niger
I go answer Grand commander of di Nation
Dem go address me as snake wey get forest
My broda
I wan bi President
Even for my papa House
But na dream I dey dream.
We’ve updated our privacy policy so that we are compliant with changing global privacy regulations and to provide you with insight into the limited ways in which we use your data.
You can read the details below. By accepting, you agree to the updated privacy policy.